BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Inec wan deploy AI for 2027 general elections - wetin e mean for di polls and how e go work?
Inec oga Joash Amupitan explain say di AI technology no be to replace humans or make independent decisions, but to complement and make di process more credible.
US announce new visa restriction policy for pipo wey dey engage in birth tourism and odas
US govment don announce new visa restriction policy for foreign nationals wey intentionally dey travel to di kontri just to born pikin, so dia pikin go be US citizen.
Hackers tiff FBI special agents blood and urine test results
Di hackers claim say dem get di name, role, badge number and personal details including home address, phone numbers and spouse information of all FBI agents.
Why EFCC declare former Nigeria pension oga Maina wanted again
Dis no be di first time 61 years old Abdulrasheed Maina go get kasala wit EFCC.
Wetin to expect from African leaders for 2026 UNGA as Shettima, Mahama, Ruto and odas represent continent
World leaders dey attend di United Nations General Assembly of 2026 and African leaders dey also make dia voice heard. Wetin dem dey tok?
South African police begin investigation as gunmen kpai eleven pipo inside house for Durban
Police for statement tok say di "Information wey dey available at dis stage suggest say 13 men and one woman, wey dem believe say get belle, bin dey do party inside one house, wen three men enta and open fire on dem."
Five key points from Trump UN General Assembly speech
US President Donald Trump deliva ogbonge speech for di ongoing 2026 United Nations General Assembly for New York.
Wetin be Rainbow Coalition and why APC govnors dey quarrel FCT Minister Nyesom Wike bicos of am?
As di 2027 presidential election dey near for Nigeria, politicians from di ruling party dey clash wit Nyesom Wike, a cabinet minister wey belong to di opposition party.
Why Tinubu no go attend UN General Assembly for di US and wetin e mean for Nigeria?
Nigeria Ambassador to di United Nations, Jimoh Ibrahim, say Nigeria go kontinue to retain special seat and status for UNGA, even though Vice President Shettima go represent President Tinubu.
Special Tori
105 Nigerians arrive from South Africa ahead of September 30 deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to comot
Foreign Ministry tok-tok pesin Adeniyi say: "efforts dey underway to evacuate more Nigerians wey dey distressed sake of safety concerns for South Africa."
Police share update ontop woman wey allegedly use sex toys on daughter for livestream video
"D Command don investigate di case and forward di case file to di Director of Public Prosecutions (DPP) for necessary legal action," Anambra police tok tok pesin say.
Australia launch urgent review afta OpenAI program hack govment health portal
Na for August wey OpenAI know about dis hack and but dem tell Australia govment for September.
'I be my husband stylist' - Olu of Warri wife tok about fashion, polygamy and education for Niger Delta
Wife of di Olu of Warri for exclusive interview tok about she and her husband dressing, education for children wey dey riverine communities and how Africa women fit break barrier against dem and how Africans fit change dia identity crisis.
Wetin we know about di US-based Ghanaian professor wey die afta im wife allegedly shoot am
Wife of one Ghana professor for di US dey face murder charges afta she allegedly shoot am. Police say di couple bin dey separated for two years wey dem bin dey di middle of divorce.
Ex-husband of woman wey kpai dia three children explain why e forgive am
Di husband of di US woman wey strangle her three young children dey talk about im grief for interview wit CBS News.
South African police arrest suspects wey dey linked to one of di deaths of women for Gauteng Province
Di police for statement on Monday, 21 September announce say dem arrest one man and two women dem suspect say get hand for di bodi of di ninth woman wey dem kill and dump her bodi for Dawn Park.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































